Wen Jehoiakim dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack dem. Jehoiakim obey King Nebukadnezzar for three years, den e kon won fight against am.
For di fourt year wey Jehoiakim, Josaya pikin bi king for Judah, God tok to Jeremaya about all di pipol for Judah. (Dis na di first year wey Nebukadnezzar dey rule for Babilon.)
kon gi-am to Baruk wey Mahseaya pikin Neraya born. I give dem to am for Hanamel, di witness wey sign di agriment and all Jew pipol wey sidan for di kourtyard, present.
“Evritin wey I don tell yu about Israel, Judah and all di nashon, make yu go rite dem put for one book. Yu go rite evritin wey I tell yu from di first time wey I tok to yu, afta Josaya just bi king kon rish naw.
Den e tell Jerahmeel wey bi en pikin, Seraya wey Azriel born and Shelemaya wey bi Abdeel pikin sey, “Make una go arrest Jeremaya and en seketry, Baruk, kom.” But God don hide dem.
So, I take anoda book kon gi-am to my seketry, Baruk and e rite evritin wey I tell am. E rite evritin wey dey di first won kon add some oda ones wey I sey make e rite, join am.
Dis na wetin E tok about Egypt and King Neko sojas for Egypt, wey King Nebukadnezzar for Babilon win for Karkemish near Eufrates River for di fourt year wen Jehoiakim bi king for Judah.
Dis na di message wey Jeremaya give di senior offisa, Seraya wey Mahseaya pikin, Neraya born and na for di time wen e follow King Zedekaya go Babilon for di fourt year wey e bi king for Judah.