“Una tink sey God nor know sey una and una grand-grand papa with una kings, ofisas and all di pipol dey burn incense give juju for Judah town and all di street for Jerusalem?
Wen una don do all dis tins wey I hate finish, una go kom stand for my present inside my temple kon dey sey, ‘Wi dey save!’ Una tink sey una really dey save wen una dey do all di tins wey I hate?
Make una remember and nor ever forget how una make di Oga una God vex for di wildaness. From di day wey una komot Egypt kon rish naw, una dey always sin against God.