Na war, honga and diziz go kill all di pipol wey gri sey dem won go stay Egypt. No one among dem go survive or eskape di wahala wey I go bring for dem.’
Judah pipol wey kom stay Egypt, nobody among dem go eskape or survive. Nobody among dem go-go back to Judah, wey dem like to go stay again. Nobody go-go back, escept some slave.’ ”
God tell en pipol wey dey Babilon, “Una don eskape deat! So make una dey go and nor wait! Even doh una dey far from una land, make una tink about mi wey bi una Oga God and una go remember Jerusalem.”
But evritin wey I tok thru my profets, happen to una grand-grand papa dem, just as I tok am. So dem turn from sin kom meet mi kon sey, ‘Oga God wey dey lead heaven sojas, na en really ponish us, just as wi deserve am. E don do wetin E sey E go do.’ ”