E sakrifice give Damaskus juju, bikos e tink sey na di juju win am. E tok for en mind sey, “Bikos Damaskus juju help en pipol, I go sakrifice gi-am, so dat e go kom help mi too.” But dis won kon make Assyria sojas distroy en and evribody for Judah.
Di wimen still sey, “Before wi bake kake wey bi like Heaven Kween or offa sakrifice or gi-am wine, wi dey first tell awa husband and dem dey gri with evritin wey wi dey do.”
“Una tink sey God nor know sey una and una grand-grand papa with una kings, ofisas and all di pipol dey burn incense give juju for Judah town and all di street for Jerusalem?