4 So Johanan, di sojas offisa and di oda pipol nor gri stay for Judah, just as God kommand dem.
Den all di pipol, from small go rish di ones wey old kon run komot di town go Egypt, bikos dem dey fear wetin King Nebukadnezzar go do dem.
As e dey tok, King Amazaya kon tell am, “Na who choose yu to advise di king? Make yu stop to profesai or dem go kill yu trowey!” Di profet stop kon sey, “I know sey God one distroy yu, bikos of dis tins wey yu do and yu nor gri listin to my advise.”
Make yu trust God and do wetin dey good, den yu go get peace for di land and yu go prosper.
So I kon si sey, wisdom betta pass pawa, but nobody go respet wise man wey poor; nobody go gri listin to en advise bikos e nor get money.
Den Johanan and di oda sojas oga karry all di pipol wey Ishmael katch as prisonas from Mizpa, afta e don kill Gedalaya.
And naw, I don tell una, but una nor one gri do evritin wey God sey make I tell una.
so I kon koll Johanan, di sojas offisa, doz wey dey with am and di oda pipol.
but dem nor gri listin or hear mi. Dem still dey offa sakrifice give oda gods.