But with all dis tins, di pipol go against Yu. Dem nor gri obey Yu and dem turn from yor law. Dem kill di profets wey kom warn and tell dem to turn kom meet Yu. Dem curse Yu many-many times,
But Judah king go against Babilon king. E go hire horse and many sojas from Egypt. Naw, with all dis one, e go fit win di fight against Babilon king? E go fit do wetin e plan? E go fit break di agriment and nobody go ponish am?
Wetin make God bring us kom dis land, so dat dem go kill us for war? Dem go katch awa wifes and shidren go as slaves! E for betta sey wi go Egypt back o-o?”
Make di king nor build big house where e go put horse, or make di pipol go back to Egypt go buy horse, bikos God don sey, “Make una nor go back to Egypt.”
Den wen wahala and sofa fall for dia head, dis song go bi witness against dem, bikos dia shidren-shidren nor go forget am. I know wetin dem dey tink for dia mind today, even before I take dem go di land wey I promise dem.”
Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.