Wen Abner rish Hebron, Joab take am go di gate side like sey e won tok to am where nobody go hear, den e shuk Abner for belle. Na so e take kill Abner, bikos e kill Asahel wey bi en broda.
But for di sevent mont, Ishmael wey bi Netanaya pikin and Elishama grand-pikin wey dey join di royal family, kom with ten of en men kon kill Gedalaya, plus all di Judah and Babilon pipol wey dey with am for Mizpa.
Wen I nor ansa, Nebuzaradan kon sey, “Make yu go back go meet Gedalaya wey Shafan pikin, Ahikam born, bikos na-im Babilon king don choose as rulers for Judah. Yu fit stay with en and di pipol or yu fit still go anywhere wey yu like to go.” Den e give mi gift and some food kon sey make I dey go.
Some among Jew ofisas and dia sojas still hide for di kountry for di hill. Wen dem hear sey Babilon king don make Gedalaya wey bi Ahikam pikin govnor for di land ova di men, wimen, shidren and doz poor pipol wey dem nor karry go Babilon as prisonas,
Ishmael wey Netanaya born; Johanan wey bi Kareah pikin; Seraya wey Efai pikin Tanhumet born wey still kom from Netofat; with Jezanaya wey kom from Maaka kon go meet Gedalaya for Mizpa with dia men.
“Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’