17 Dem take all of dem go Gerut Kimham village near Betlehem and dem from der go Egypt.
Make una nor sey, ‘No! E betta make wi go Egypt instead of us to stay dis land, bikos for der, wi go dey free from war and food plenty for der wey wi go chop.’
“I still tell dem, ‘God don tell una wey remain for Judah sey make una nor go Egypt.’ So I dey warn una,
Den Johanan kon karry doz wey remain for Judah; both di men, wimen, shidren, di king dotas and di pipol wey kom from oda nashons, go Egypt.
Dem nor obey wetin God kommand and dem kon go Tahpanhes town for Egypt.