Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 41:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Den di king dota and all di rest pipol for Mizpa wey Nebuzaradan put for Gedalaya kare, Ishmael kon karry all of dem go Ammon land as prisonas.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 41:10
13 Iomraidhean Croise  

But wen Sanballat, wey kom from Bet-Horon town and Tobaya, one offisa for Ammon aria, hear sey somebody don kom help Israel pipol, dem kon dey vex well-well.


Wen Sanballat, Tobaya and one Arab man wey en name bi Geshem, hear wetin wi dey plan to do, dem kon dey laf us sey, “Wetin una tink sey una dey do so? Una won fight against di king?”


God sey, “Make yu rite dis man name as pesin wey nor get pikin and wey nor go ever susid for life. En shidren nor go ever rule for David throne for Judah again.”


Den I sey, “Dem go take all yor wifes and shidren go give Babilon pipol and yu too nor go fit eskape. Babilon king go katch yu as prisona and dem go burn dis town rish groun.”


Dem force Zedekaya make e dey look as dem dey kill all en shidren and en ofisas for Riblah.


e kon tell am, “Yu nor know sey, ‘King Baalis for Ammon don send Ishmael make e kom kill yu?’ ” But Gedalaya nor bilive dem.


Some among Jew ofisas and dia sojas still hide for di kountry for di hill. Wen dem hear sey Babilon king don make Gedalaya wey bi Ahikam pikin govnor for di land ova di men, wimen, shidren and doz poor pipol wey dem nor karry go Babilon as prisonas,


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan