12 So dem komot from where dem dey kon go stay Judah. Dem kom meet Gedalaya for Mizpa and dem harvest many wine and fruit for der.
Wen grass die, new ones go appear and di plants for mountins go grow again,
So, I kry for Sibmah vine, just as I kry for Jazer. I dey kry for Heshbon and Elealeh pipol, bikos dem distroy all di food wey dem plant.
Mi too, go stay for Mizpa to tok for una wen Babilon pipol kom here. Una fit gada and store wine, fruit and olive oil kon stay for di village wey una don choose.”
Afta, Johanan and di sojas oga wey hide before, go meet Gedalaya for Mizpa,
Den di king dota and all di rest pipol for Mizpa wey Nebuzaradan put for Gedalaya kare, Ishmael kon karry all of dem go Ammon land as prisonas.
Den Johanan kon karry doz wey remain for Judah; both di men, wimen, shidren, di king dotas and di pipol wey kom from oda nashons, go Egypt.
But since wi stop to sakrifice and pour wine give Heaven Kween, wi nor get anytin again and war with honga don early kill awa pipol finish.”
So my sheep kon dey waka anyhow on-top di hills and mountins. Dem skata for evriwhere for di eart and nobody dey to guide or look for dem.