Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 40:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 By dat time, Israel pipol wey dey Moab, Ammon, Edom and oda kountry hear sey Babilon king allow some Israel pipol stay for Judah and e don make Gedalaya dia govnor.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 40:11
23 Iomraidhean Croise  

So Esau (wey still bi Edom) kon go stay for di hill for Seir.


Dem go attack Filistia pipol togeda for di west kon kill di pipol wey dey east. Dem go distroy Edom and Moab pipol and Ammon pipol go dey obey dem.


Abeg! Make una allow us stay with una, so dat una go protet us from awa enemies! Wen doz wey opress us don die and distroshon nor dey again and awa enemies don disappear,


I go give dem wahala sotey all di nashons for di world go fear. Pipol go laf dem well-well; use dem dey make yeye kon dey curse dem for anywhere wey I skata dem go.


Den di king dota and all di rest pipol for Mizpa wey Nebuzaradan put for Gedalaya kare, Ishmael kon karry all of dem go Ammon land as prisonas.


Den Johanan kon karry doz wey remain for Judah; both di men, wimen, shidren, di king dotas and di pipol wey kom from oda nashons, go Egypt.


Evribody wey Nebuzaradan wey bi di sojas oga leave for Gedalaya kare, dem karry dem go Egypt. Dem still karry mi and Baruk follow body.


I go ponish Egypt, Judah, Edom, Ammon, Moab and di pipol for desert wey kut dia hair short for di temple. Even for Israel, nobody wey dem sekonsaiz, keep my kovenant for en heart.”


God wey get pawa sey, “Edom pipol revensh Judah well-well and dat revensh don make Edom pipol sin.


“Man pikin, turn face Ammon kon tok against en pipol.


Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Una klap una hand kon dey jump with happiness and dey curse Israel land.


God wey get pawa sey: “Bikos Moab pipol sey Judah bi like di oda kountries,


So my sheep kon dey waka anyhow on-top di hills and mountins. Dem skata for evriwhere for di eart and nobody dey to guide or look for dem.


just as una dey happy wen Israel skata; Israel land wey bi my own. Mount Seir pipol and all of una for Edom go die finish. Den evribody go know sey na mi bi God.’ ”


“ ‘Na una bi di enemy wey dey worry and kill Israel pipol wen dem dey wahala and dat time na dia final ponishment for dia sin, dem dey face.


Some of una go die bikos of honga; sickness go kill some; swod go kill anoda set for outside di town and di remain wons, I go skata dem for air kon porshu dem with my swod.


Make yu keep and tie some of di hair for yor klot.


Israel pipol kon travel go Moab for Jordan River for di oda side for Jeriko.


Wen Israel pipol dey for Shittim, dem kon dey sleep with Moab wimen.


Dis wimen invite di pipol kom dia juju festival; den di pipol chop and woship dia juju.


Nahash dem wey bi Ammon pipol kon mash dey go fight Jabesh pipol. All di men for Jabesh kon tell Nahash pipol, “Make wi make peace with una and wi go serve una.”


“Wen una si sey King Nahash for Ammon dey kom fight una, una sey, ‘No! Wi wont king’, even doh na di Oga una God bi una king!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan