Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 40:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Mi too, go stay for Mizpa to tok for una wen Babilon pipol kom here. Una fit gada and store wine, fruit and olive oil kon stay for di village wey una don choose.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 40:10
15 Iomraidhean Croise  

Wen David don pass di hill small, e kon si Ziba wey bi Mefiboshet savant. E bring some donkey wey karry two hundred bread and some kake; one hundred fresh fruit and one leda bag wey wine full.


Yor ofisas and savants go dey happy well-well, bikos dem always dey with yu, dey hear di wise tins wey yu dey tok!


Yu don si pesin wey get good work? E dey-dey with kings and nor bi with yeye pipol.


Wen grass die, new ones go appear and di plants for mountins go grow again,


So, I kry for Sibmah vine, just as I kry for Jazer. I dey kry for Heshbon and Elealeh pipol, bikos dem distroy all di food wey dem plant.


So mi, wey bi Israel God promise sey, “Jehonadab wey bi Rekab pikin, go always get one of en sons wey go serve mi.”


But e leave some poor pipol kon give dem vineyard and farm, so dat dem go dey work for der.


So dem komot from where dem dey kon go stay Judah. Dem kom meet Gedalaya for Mizpa and dem harvest many wine and fruit for der.


Gedalaya wey bi Ahikam pikin, I go stay en house for Mizpa kon dey with my pipol wey remain for di town.


Den Johanan kon karry doz wey remain for Judah; both di men, wimen, shidren, di king dotas and di pipol wey kom from oda nashons, go Egypt.


I go kry well-well for Sibmah and Jazer pipol. Sibmah town, yu bi like vine wey en branches rish Dead Sea den kon go Jazer town. But naw, yor fruit and grape wey yu plant for dry sizin, don skata.


E don finish for mi! I bi like pesin wey nor si fruit chop or si fruit pick afta dem don harvest evritin.


But make una dey shine una eye evritime, dey pray make God give una pawa take pass all dis test wey go happen, so dat una go fit stand for Man Pikin front.”


But na Nun pikin Joshua wey dey assist yu go enter. So make Yu enkourage am, bikos na en go lead Israel pipol enter di land.


Make una celebrate Shelta Feast for seven days for di time wen una dey harvest una plant and grapes.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan