Jeremaya 40:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
1 God tok to mi afta Nebuzaradan, wey bi di sojas oga don free mi for Rama. Na shain dem bin take dey karry mi as prisona go Babilon with all di oda pipol from Jerusalem and Judah.
For thirty-six years wen Asa dey rule for Judah, King Baasha for Israel kon attack Judah. E put sojas for Rama, so dat nobody go enter or komot from di town.
God dey find place put pipol wey don run komot from dia house bikos of war, E dey free prisonas kon make dem prosper. But pipol wey dey sin, dey stay for desert forever.
Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di fift day for di tent mont, one man wey eskape from Jerusalem, kom tell mi sey, “Di town don fall.”
But Paul ansa, “Wetin una dey do so, una dey kry dey won break my heart? I ready, nor bi only make dem tie mi, but to die for Jerusalem, bikos of Jesus Christ name.”