Jeremaya 4:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
22 But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”
But doz wey dey opress oda pipol, nor know anytin at-all. Dem bi fools! Dem dey waka anyhow for darkness, while all di foundashon for di eart dey skata.
Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
Black man fit shange en skin kolour, abi leopard fit komot di mark wey dey en body? If dem nor fit, den e go hard for wiked pesin to do good, bikos na only to do bad tins, e sabi.
Una priests nor even ask sey, ‘Where Oga God dey?’ Doz wey dey tish my law nor even know mi. Una rulers don turn from mi. Una profets dey profesai with Baal name and una leaders dey woship juju wey nor fit help or save dem.
So I kon sey, “Na only poor and foolish pipol dey bihave like dis. Dem dey bihave like fools, bikos dem nor know wetin God wont. Dem nor know wetin dia God wont make dem do.
God sey, “Dis pipol bi like sojas wey don ready dia bows. Dem always dey ready to lie, bikos of dis, dem don get pawa for di land, but na wayo dem take get am. Dem don do many bad tins and dem nor dey tink of mi wey bi dia God.
My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.
E go bad for doz wey nor dey sleep for nite, bikos of di bad tins wey dem dey tink and plan to do. For early morning, dem go rush go do wetin dem plan, bikos dem get pawa to do am.
“Di oga praiz di wayo manaja, bikos of di wayo sense wey e use. Bikos dis world pipol sabi use dia wayo sense for business pass pipol wey dey for lite.
I dey happy, bikos evribody don know how una dey obey God. But I wont make una dey wise wen e rish matter wey koncern wetin dey good or bad. Make una nor do any bad tin.
My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.