But with all dis tins, di pipol go against Yu. Dem nor gri obey Yu and dem turn from yor law. Dem kill di profets wey kom warn and tell dem to turn kom meet Yu. Dem curse Yu many-many times,
Bikos of yor love, Yu dey patient with dem for many years. Yu send yor Spirit wey warn dem thru di profets. But yet, dem nor gri listin! So Yu allow oda nashons attack dem again.
and for di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar lead en sojas go fight against Jerusalem. Dem surround di town kon build dia tent near di wall.
Jerusalem sey, “God dey rite, bikos I go against en kommand. So pipol for evriwhere, make una listin kon si as I dey sofa! Dem don karry my shidren go Babilon as slave.
Bikos Jerusalem sin well-well, God kon rijet dem like dirty rag. All di pipol wey dey honor am before, don hate am naw, bikos dem don si en nakednes and shame. Di only tin wey e fit do naw, na to dey kry with pain and hide en face with shame.