Like dis, I go ponish my pipol for Jerusalem and Judah, bikos of dia wikedness. Dem forget mi kon dey woship and offa sakrifice give juju and oda gods wey dem make with dia own hand.
“For dat time, dem go tell Jerusalem and Judah pipol sey, “ ‘I dey kommand one strong breeze kom from di desert kom meet my pipol. Di breeze nor bi to blow well or to klean my pipol,
Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”