Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 39:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Wen King Zedekaya and all en sojas si wetin dey happen, dem kon try to run komot for di town for nite. Dem pass di gate wey join di two wall for back near di king gardin kon go Jordan River Valley.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 39:4
17 Iomraidhean Croise  

King Hezekaya use all en pawa take build di wall wey dem break. E build towa and wall for outside kon fence David Town round. E make many weapons and shields.


Una make somewhere inside di town where una go dey store wota wey dey flow kom from di old pool. But una nor trust God wey make am. Una nor gri depend on God wey make all dis tins.


Una leaders run, but dem katch dem without any fight or sey dem shot arrow. Even wen di pipol try to run, dem still katch dem too.


But mi God go bring wahala kom di town; dem go mourn and kry and e go bi like my altar where dem for dey do sakrifice.


and yu, King Zedekaya, nor go eskape. Dem go give Zedekaya to Babilon king and both of dem go tok face-to-face.


Dem go take Zedekaya go Babilon and e go stay der until I don deal with am finish. Even if e fight Babilon pipol, e nor go win. Mi, wey bi God, don tok.’ ”


“Di priest among una go karry en load put for shoulder kon waka enter darkness. E go break di wall where e go trow en load pass. E go kover en face, so dat e nor go si di land with en eye.


For aftanoon wen dem still dey look yu, karry di tins wey yu pak like sey yu dey go Babilon. Wen dem still dey look yu, komot der for evening like sey yu dey go anoda place.


I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.


“I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una.


Even doz wey dey run fast nor go fit eskape; strong men nor go get pawa again and sojas nor go fit save dia own life.


God go still allow una enemies beat una; una go attack dem from one side, but una go run komot seven side, den all pipol for di eart go dey fear bikos of wetin hapun to una.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan