God still tok to am, wen Josaya pikin, Jehoiakim dey rule for Judah. Afta dat time, God still tok to am until di fift mont for di elevent year wen Zedekaya wey Josaya born, dey rule for Judah and na dat same year, dem katch and karry Jerusalem pipol go Babilon.
Bikos mi God don sey, I go orda dem and dem go kom di town again. Dem go attack, seize and burn am rish groun. I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.’ ”
So God kommand di enemies sey, “Make una go distroy di vines for Israel and di vineyard for Judah, but nor distroy dem finish. Kut dia branches komot, bikos doz branches nor bi God own.
Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di fift day for di tent mont, one man wey eskape from Jerusalem, kom tell mi sey, “Di town don fall.”
Make yu take one iron pan kon set am up like wall between yu and di town. Den turn make yu face Jerusalem to show sey dem nor go fit eskape wen dia enemies dey kom distroy dem. Dis go bi warnin to Israel pipol.
Burn di third part for fire afta yor work don finish. Take anoda part kon kut am anyhow for outside di town. Den make yu skata di remainin part for air and I go use my swod take distroy dem.
God sey, “For dat day, pipol go kry dey kom from di Fish Gate and dem go dey shaut from di new house dem wey dey di town. And una go hear strong nois from di hills.
“Di fasting wey Judah pipol dey do for di fourt, fift, sevent and tent mont, go kon bi festival for joy and for betta tins. Una must love trut and peace.”