E allow Babilon king kill all dia yong men for dia temple. E nor sorry for di yong men or wimen, or even di old pipol. God give all of dem to Babilon king.
Bikos mi God don sey, I go orda dem and dem go kom di town again. Dem go attack, seize and burn am rish groun. I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.’ ”
Bikos Israel God sey, ‘Just as I pour my vexnashon and fire for Jerusalem pipol, na so too, I go pour my vexnashon for una head, if una go Egypt. Pipol go si una dey fear, dem go hate and use una name as curse. Una nor go ever si dis place again.’
Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule Judah and e rule Jerusalem for eleven years. En mama name na Hamutal and na Jeremaya wey dey stay Libnah town, born am.
Dis na wetin Oga God wey dey mighty tok, “Make una kut all di trees for Jerusalem trowey kon build wall round am. I must ponish dis town, bikos opreshon full am.
Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di fift day for di tent mont, one man wey eskape from Jerusalem, kom tell mi sey, “Di town don fall.”
Make yu take one iron pan kon set am up like wall between yu and di town. Den turn make yu face Jerusalem to show sey dem nor go fit eskape wen dia enemies dey kom distroy dem. Dis go bi warnin to Israel pipol.
Twenty-five years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di tent day for di new year wey bi di fourteent year afta dem skata Jerusalem, God kon tosh mi with en hand and E take mi enter di town.
Burn di third part for fire afta yor work don finish. Take anoda part kon kut am anyhow for outside di town. Den make yu skata di remainin part for air and I go use my swod take distroy dem.
“Di fasting wey Judah pipol dey do for di fourt, fift, sevent and tent mont, go kon bi festival for joy and for betta tins. Una must love trut and peace.”
God go karry una with di king go meet pipol wey una with una grand-grand papa neva hear of before and una go serve and woship gods wey dem make with wood and stone.