Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 38:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 ‘For di vishon, I si sey, dem karry all di wimen wey remain for Judah royal palis go meet Babilon ofisas and dis na wetin dem dey tell di king: “ ‘ “Na yor best friends give yu wrong advise, dem dey kontrol yu and naw wey yu don enter trobol, all of dem don run leave yu.” ’ ”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 38:22
22 Iomraidhean Croise  

But my friends, una don show sey una bi like wota wey dry bikos rain nor fall!


Even my best friend, di one wey I trust with evritin; pesin wey wi dey chop togeda, don turn against mi.


Make Yu save mi from di mud! Nor let mi sink! Diliver mi from pipol wey hate mi and from di deep wota!


I dey sink enter mud; di place wey di groun soft well-well. I dey for deep wota and di wota dey karry mi go.


But for all of una wey trust juju, wey dey koll image una gods, dem go sofa and disgrace una.”


Wetin una go tok wen di pipol wey una bin tink sey bi una friends katch, distroy and kon dey rule una? E go pain una like woman wey won born?


I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”


Nor listin to di profets wey sey make yu nor surenda to am; dem just dey deceive yu.


God don sey, ‘I nor send dem and dem dey lie give yu with my name.’ So E go drive yu komot and dem go kill both yu and di profets wey dey lie give yu.”


But di king ansa, “I dey fear awa own pipol wey don already surenda to Babilon king. Babilon king fit give mi to dem and dem go sofa mi.”


But if yu nor gri surenda, dis na wetin God show mi sey go happen:


Den di king dota and all di rest pipol for Mizpa wey Nebuzaradan put for Gedalaya kare, Ishmael kon karry all of dem go Ammon land as prisonas.


Evribody wey Nebuzaradan wey bi di sojas oga leave for Gedalaya kare, dem karry dem go Egypt. Dem still karry mi and Baruk follow body.


Even di sojas wey dem hire lazy like small goat. Instead make dem stand fight, na run dem dey run. Di day for dem to face wahala and ponishment, don kom.


But God ask, “Na wetin I dey si so? Dem dey turn back, bikos of fear. Babilon sojas win dia sojas and dem kon run. Dem fear kon kwik-kwik run and dem nor even look back.


Dem go give dia house, wifes and farms to anoda pesin. I go ponish di pipol wey dey dis land.


So, I go give dia wifes to oda men kon give dia farm to oda pipol. I go do am, bikos both rish and poor pipol dey use wayo take dey get dia money. Even profets and priests don join dey deceive pipol too.


E send fire kom from heaven and e dey burn inside my bone. E set trap for mi and I fall enter. Naw E don forget mi and I dey sofa well-well.


Jerusalem pipol dey kry well-well for nite. Doz wey love am nor dey again to konfort am and all en friends don lie for en head; dem don turn en enemy.


Enemies don rape awa wifes for Jerusalem and dem don disgrace awa yong girls for Judah town.


So make una nor trust anybody; even if di pesin na una best friend or wife!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan