and burn am rish groun. Dem go burn am with di house where pipol for don make mi vex, bikos dem dey burn incense give Baal juju on-top di house and dey pour wine as ofrin give oda gods.
Di Oga wey bi Israel God sey, “Make yu go tell King Zedekaya for Judah sey, ‘Mi, wey bi God, go give dis town to Babilon king and e go burn am rish groun.
Den I sey, “Dem go take all yor wifes and shidren go give Babilon pipol and yu too nor go fit eskape. Babilon king go katch yu as prisona and dem go burn dis town rish groun.”