Egypt king with en men nor komot from dia land again go fight, bikos Babilon king don konker evriwhere wey Egypt king bin get before from Egypt wotaside go rish Eufrates River.
“Make yu tell Zedekaya wey sey make yu pray make I help dem sey, ‘Egypt sojas wey bin dey kom help yu, go-go back to dia town wen dem don help yu finish.’
But Judah king go against Babilon king. E go hire horse and many sojas from Egypt. Naw, with all dis one, e go fit win di fight against Babilon king? E go fit do wetin e plan? E go fit break di agriment and nobody go ponish am?