14 So I ansa, “No o-o! I nor dey spy for Babilon sojas o-o.” But Irijah nor gri listin to mi, so e arrest mi kon take mi go meet di ofisas.
I ansa am, “All wetin yu tok so, nor bi true. Na only yu arrange dis story.”
Nor let mi fall enter dia hand, bikos dem dey akuiz mi for wetin I nor do and dem always dey treaten mi.
Wiked pipol dey lie for my head. Dem dey akuiz mi about bad tins wey I nor do.
Curse dey una head, una wey pipol dey tok good tins about, bikos na so dia grand-grand papa dem tok about di fake profets too.
But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok.