Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 37:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 But wen I rish Benjamin Gate, Irijah wey Hananaya pikin Shelemaya born wey bi di guards oga kon stop mi dey sey, “Na Babilon sojas send yu kom spy dis land!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 37:13
20 Iomraidhean Croise  

Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”


I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”


e kon oda sey make dem beat and tie mi with shain, den put mi for one room near Benjamin Gate for di temple.


War or honga go kill anybody wey dey di town, but doz wey go kom out kon surenda give Babilon king, nor go die; dem go eskape with dia life.


Na mi put di nashons under my savant pawa, King Nebukadnezzar for Babilon and I kon make wild animals dey serve am.


Israel God wey dey mighty dey sey, ‘I don put iron yoke for dis nashon and dem go serve King Nebukadnezzar for Babilon. I go even make wild animals serve Babilon king.’ ”


So e go di kourt seketry room for di royal palis where all di ofisas dey. Elishama, di kourt seketry, Delaaya, wey bi Shemaya pikin, Elnatan wey bi Akbor pikin, Gemaraya wey Shafan born, Zedekaya wey Hananaya born and all di oda ofisas sidan for der.


Shefataya wey bi Mattan pikin; Gedalaya wey Pashhur born; Jehucal wey bi Shelemaya pikin and Pashhur wey Malkijah born kon hear wen I dey tell di pipol sey,


Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”


Ebed Melek, one Ethiopia man wey dey work for di palis, hear sey dem put mi for di well. And by dat time, di king get kase wey e won judge for Benjamin Gate.


Awa enemies dey wosh awa movement and naw, wi nor fit waka for di street again. Awa days for dis world don almost finish, bikos wi go soon die.


Amazaya wey bi priest for Bethel kon send message go give King Jeroboam for Israel sey: “Among all di pipol, na Amos dey plan against yu and di land nor go fit bear all wetin e dey tok.


All di land from Gibeah aria go rish Rimmon wey dey di sout, go klean like Arabah. But Jerusalem go high pass oda land wey dey round am; di town go start from Benjamin Gate go rish di Korna Gate kon from Hananel Towa go di Royal Wine press.


dey akuiz am sey, “Wi hear dis man wen e dey deceive and tell awa pipol sey make dem nor pay tax give Caesar and e dey tok sey naim bi Christ, wey bi king.”


dem nor fit show yu di offence wey dem akuiz mi sey I kommit.


So, dem kon bribe some men make dem lie sey, “Wi hear wen dis man tok tins wey dey against Moses and God law.”


for di time wey dem honor or disgrace us; for di time wen dem tok bad about us or praiz us; di time wey dem do us like sey wi dey tok lie, but wi dey tok trut.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan