Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 36:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 So, I take anoda book kon gi-am to my seketry, Baruk and e rite evritin wey I tell am. E rite evritin wey dey di first won kon add some oda ones wey I sey make e rite, join am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 36:32
13 Iomraidhean Croise  

God kon tell Moses, “Make yu kut two stones kom out like di first ones wey yu skata, den I go rite di same word put for dis ones.


Baruk ansa, “Na Jeremaya tell mi evritin wey I rite with ink for dis book.”


As Jehudi read three or four line finish, di king vex, kut dat part for di book komot with knife kon trow am for di fire. Na so e do until e burn di whole book finish.


So, I koll Baruk wey bi Neraya pikin kon tell am evritin wey God tell mi and Baruk rite evritin put for one book.


King Nebukadnezzar vex well-well and en face kon dey red for Shadrak, Meshak and Abednego. Den e orda sey make dem heat di fire seven time, so dat e go hot well-well.


Di first year wen Belshazzar bi king for Babilon, Daniel dream one kind dream kon si plenty vishon wen e dey sleep, so e rite di dreams for book.


“If afta all dis tins happen and una nor still obey mi, I go inkrease una ponishment seven times.


“If una kontinue to rijet mi and una nor gri obey mi, I go inkrease una ponishment seven times again.


I go turn kon ponish una seven times and e go worse pass di ones wey I ponish una before.


I go turn against una. Bikos I dey vex, di ponishment wey I go give una go bad seven times pass di ones wey I give una before.


Even mi, Tertius wey rite dis leta, dey greet una with Christ name.


I dey warn evribody wey dey read di profesy wey dem rite for dis book: If anybody add join wetin dey dis book, di wahala wey dey dis book, God go add am join en life.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan