Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 36:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 But even as di king and all en ofisas hear evritin, dem nor still fear or turn from sin kom meet God.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 36:24
20 Iomraidhean Croise  

Leta, wen Reuben go back to di gutta, e kon si sey Josef nor dey der again! E tear en klot


Den Jakob tear en klot kon wear sak for body and e mourn for en pikin well-well.


David and all en men kon vex tear dia klot.


Wen Elijah tok finish, King Ahab tear en klot kon wear sak klot. E nor gri chop; e sleep with di sak klot and e kon dey sorry for ensef.


Yu nor dey fear God? Yu nor dey respet am at-all?


Wiked pipol nor get good heart and dem nor dey fear God.


Bikos dem blind, dem nor fit si as dem really wiked rish.


Dem dey enkourage each oda to do wiked tins and dey plan how to set trap for sekret kon dey make mout sey, “Nobody go ever know or si us!”


So Fero go inside en house back. E nor even allow wetin happen worry en mind.


My God, even doh Yu don dey ready to ponish wiked pipol, dem nor still know sey Yu won ponish dem. Dem go si am and shame go katch dem wen dem si how Yu go take judge yor enemies for di world.


Den Eliakim, Shebna and Joah vex tear dia klot kon go tell di king wetin Assyria offisa tok.


As King Hezekaya hear di ripot, e vex tear en klot kon wear sak klot go God temple.


Afta e read finish, dem look demsef kon dey sopraiz, so dem tell Baruk, “Wi must go tell di king about all dis tins.”


My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.


Wen dia king hear di news, e get up from en throne, remove en fine klot, wear sak kon sidan for ashes.


For judgement day, Nineveh pipol go kondemn di pipol for dis time, bikos wen Jonah prish give dem, dem turn from sin kom meet God. And naw, somebody wey big pass Jonah dey here with una!


Dem nor dey fear God at-all.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan