So e go di kourt seketry room for di royal palis where all di ofisas dey. Elishama, di kourt seketry, Delaaya, wey bi Shemaya pikin, Elnatan wey bi Akbor pikin, Gemaraya wey Shafan born, Zedekaya wey Hananaya born and all di oda ofisas sidan for der.
Den di king tell Jehudi, “Make yu bring di book kom.” So, Jehudi go bring di book kom from Elishama room kon read am give di king and en ofisas wey stand round am.