As long as yor Oga my God dey alive, I dey tell yu sey, my oga don send pipol go evriwhere go find yu. Wen dem tell am sey, ‘Yu nor dey der,’ e go make sure sey dem swear sey dem nor really si yu.
Den e tell Jerahmeel wey bi en pikin, Seraya wey Azriel born and Shelemaya wey bi Abdeel pikin sey, “Make una go arrest Jeremaya and en seketry, Baruk, kom.” But God don hide dem.
So Amazaya sey make dem tell Amos, “Komot for here, yu wey dey profesai! Yor tok don too mush! Make yu go Judah town and kontinue to prish for der, so dat dem go pay yu.
So dem bring di apostles kom back kon tell dia savant make dem flog dem. Afta dem release dem, dem kon warn dem sey make dem nor use Jesus Christ name take prish again.