Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 36:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 So e go di kourt seketry room for di royal palis where all di ofisas dey. Elishama, di kourt seketry, Delaaya, wey bi Shemaya pikin, Elnatan wey bi Akbor pikin, Gemaraya wey Shafan born, Zedekaya wey Hananaya born and all di oda ofisas sidan for der.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 36:12
13 Iomraidhean Croise  

Di king kon orda Priest Hilkaya, Shafan pikin Ahikam, Mikaya pikin Akbor, Shafan wey bi di kourt seketry and Asaya wey bi di king savant sey,


So Priest Hilkaya, Ahikam, Akbor, Shafan and Asaya kon go meet Profetes Hulda wey bi Shullam wife. Shullam papa na Tikvah and na Harhas wey dey kare for di wardrobe bi en grand-papa. (Di woman dey stay for Mishneh aria for Jerusalem.) Dem go meet am kon tell am wetin make dem kom,


For eighteen years wen King Josaya dey rule, di kourt seketry Shafan wey bi Azalaya pikin and Meshullam grand-pikin, go God Temple kon sey:


Jehoiashin na eighteen year wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama na Nehushta and na Elnatan wey kom from Jerusalem, born am.


Wen di leaders hear wetin happen, dem rush kom di temple from di royal palis. Dem kon form one kourt for where di New Gate for God temple dey.


Den King Jehoiakim send Akbor pikin Elnatan and some oda men go Egypt go katch Uriaya kom.


So dat day, Ahikam wey bi Shafan pikin, support and help mi, so dat di pipol nor go kill mi.


Even doh Elnatan, Delaaya and Gemaraya beg di king sey make e nor burn di book, e nor listin to dem.


Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”


For di sevent mont for dat same year, Ishmael wey Elishama pikin, Netanaya born, wey still bi memba for di royal family and one of di king main offisa kon go meet Gedalaya for Mizpa and e karry ten men follow body. Wen all of dem dey chop togeda,


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan