8 “So wi, awa wifes, sons and dotas dey obey wetin awa grand-grand papa, Jehonadab kommand us and since den, wi neva drink wine;
Pikin wey get sense dey listin to en papa and mama word, but doz wey dey foolish, nor dey take korreshon.
So my pikin! Make yu listin to mi; make yu take evritin wey I dey tell yu sirious, den yu go get long life.
My pikin, make yu do wetin yor papa tell yu and nor ever forget wetin yor mama tish yu.
Shidren, as una know God, make una dey hear una papa and mama word, bikos na wetin una suppose do bi dat.
Una wey bi pikin, make una dey obey una papa and mama for evritin, (dey do evritin wey una papa and mama tok), bikos na wetin Christ like bi dat.