But Jehonadab shidren-shidren obey wetin e kommand, wen e sey make dem nor drink wine. And until naw, dem neva drink wine. Even doh I dey always tok to una, una nor gri obey mi.
Oga wey bi Israel God wey dey rule all of us sey, Make una shange from di kind life wey una dey live kon do di rite tin. If una shange, I go allow una stay for dis land.’
Oga God ask di priests, “Pikin dey honor en papa and savant dey respet en masta, but wetin make una nor dey honor mi wey bi una papa? If I bi una masta, why una nor dey respet mi? Una nor dey respet mi, yet una dey ask, ‘How wi nor take dey respet Yu?’