10 Na tent wi dey stay and wi dey obey evritin wey Jehonadab awa grand-grand papa, kommand us.
But dem ansa, “Wi nor dey drink wine, bikos awa grand-grand papa Jehonadab wey Rekab born tell us sey, make wi nor ever drink wine.”
E still tell us sey, make wi nor build house, plant anytin or buy any vineyard for awasef. E kommand us sey make wi dey stay for tent, so dat wi go fit stay for dis land wey wi dey stay like strenjas.
Make una stay for anoda place for seven days; all of una wey kom from Israel must stay der,