Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 34:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 and dat time, Babilon king and en sojas dey attack di town. Di sojas still attack Lakish and Azeka, di only oda strong town wey remain for Judah.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 34:7
18 Iomraidhean Croise  

Dem plan against am for Jerusalem, so e run go Lakish. But dem send some men go find and kill-am for der.


Wen di shief adviser hear sey Assyria king don komot from Lakish go fight for Libnah; e kon go der go meet am.


E build towns for di hill side for Judah kon build strong place and towas for di forest.


Den e kommand en offisa oga sey make e karry plenty sojas from Lakish go Jerusalem kon tell King Hezekaya sey make e surenda. So, di ofisas take-ova di road where di pipol for dey wosh and dry klot, near di Uppa Pool.


Den, Judah and Jerusalem pipol go kry go meet di gods wey dem dey sakrifice to, so dat dem go kom help dem. But doz gods nor go fit save dem wen di wahala start.


Wen King Nebukadnezzar for Babilon, en sojas with oda sojas from di kingdoms wey e dey rule, attack Jerusalem and Judah, God kon tok to mi.


God sey, “Blow di trumpet for di land! Shaut kon gada evritin togeda! Den tell Judah and Jerusalem pipol sey, make dem run go stay di strong towns.


Di pipol kon ask demsef, “Wetin make us just sidan for here? Make wi run go di strong towns, so dat even if wi go die, den wi go fight die for der. Since di Oga awa God don sey wi go die; E don give us poizin drink, bikos wi sin against am.


Lakish pipol, make una karry una horse and propaty run. Na una bi di first town for Judah wey join Israel pipol sin and una kon make Jerusalem pipol, sin too.


Dem go attack una towns until all di strong walls, (di walls wey una trust sey go protet una) go fall rish groun. Dem go attack all di towns for di land wey di Oga una God don give una.


So king Adoni-Zedek for Jerusalem kon send message go meet King Hoham for Hebron, King Piram for Jarmut, King Jafia for Lakish and King Debir for Eglon:


So di five kings wey kom from Jerusalem, Hebron, Jarmut, Lakish and Eglon, with all dia sojas kon gada go fight Gibeon pipol.


Jarmut king, Lakish king,


Jarmut, Adullam, Soko, Azeka,


Lakish, Bozgat, Eglon,


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan