6 Den I kon go tell King Zedekaya dis message for Jerusalem
Make yu tell am, ‘Mi wey bi God sey, “Afta yu don kill pesin finish, yu won still take en propaty too?” ’ Still tell am sey, ‘Na for where dog for lick Nabot blood, na der too, dogs go for lick yor own blood!’ ”
But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go only tok wetin God sey make I tok!”
So I ansa, “My Oga God, I nor sabi tok well and I still yong too.”
So God stresh en hand kon tosh my mout, den E sey, “Make yu listin, na mi go tell yu wetin yu go tok.
Yu go tell dem evritin wey I sey make yu tok, weda dem listin or not, bikos I know sey dem sturbon well-well.
“E marry Herodias wey bi en broda Filip wife.”
Bikos I nor hide anytin from una, as I dey tell una about God plan.
So Samuel tell Eli evritin. E nor hide anytin from am. Eli kon sey, “Make God do wetin E like.”