Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 34:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Yu nor go fit eskape and dem go katch yu give di king. Yu go si and tok to am one-on-one, den dem go take yu go Babilon.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 34:3
18 Iomraidhean Croise  

Naw, mi, God promise sey, “King Zedekaya with en ofisas and doz wey survive di war, di honga and diziz, I go give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and to dia enemies wey won kill dem. King Nebukadnezzar go kill dem with swod and e nor go pity or sorry for dem at-all.” ’ ”


Dem go karry dem go Babilon until di day wey I go remember dem. Den, I go bring una kom back kon give una evritin wey una don lost for dis place. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”


So, mi wey bi God sey, “I go give dis town to King Nebukadnezzar for Babilon and en sojas and dem go seize


King Zedekaya put mi for prison, bikos I tell am sey, “God sey, ‘I go allow Babilon king seize dis town


and yu, King Zedekaya, nor go eskape. Dem go give Zedekaya to Babilon king and both of dem go tok face-to-face.


I go still give King Zedekaya and en ofisas to pipol wey won kill dem. I go make Babilon sojas katch dem, even doh dem don stop di fight for naw.


Zedekaya, make yu listin to wetin I dey tok about yu. Dem nor go kill yu for war and


Afta, King Zedekaya sey make dem koll mi kom, den e take mi go korna kon ask, “God give yu any message for us?” I ansa, “Yes! E give mi.” Den I sey, “Babilon king go kom katch and karry yu go.”


But if yu nor surenda, Babilon pipol go take dis land; dem go burn di town rish groun and yu nor go fit eskape from dem.’ ”


Den I sey, “Dem go take all yor wifes and shidren go give Babilon pipol and yu too nor go fit eskape. Babilon king go katch yu as prisona and dem go burn dis town rish groun.”


Den I go trow my net on-top am kon katch am with my trap. I go take am go Babilon wey bi Kaldea pipol land (but e nor go si am) and na der e go for die.


But Judah king go against Babilon king. E go hire horse and many sojas from Egypt. Naw, with all dis one, e go fit win di fight against Babilon king? E go fit do wetin e plan? E go fit break di agriment and nobody go ponish am?


“As long as I bi God wey nor dey die, dis king go die for Babilon, bikos e break di agriment wey e make with Babilon king wey put am for di throne.


Una wey bi wiked and bad leaders for Israel! Di day wey God go ponish una, dey kom.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan