Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 34:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 But afta, dem shange dia mind kon force dem to work as slave again.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 34:11
25 Iomraidhean Croise  

but make Yu ponish pipol wey dey do bad tins. Ponish dem with all di oda wiked pipol. Make peace always dey Israel land!


Evritin wey dem tok na lie and dem dey deceive pipol. Dem nor dey ever gri do good tins.


But wen Fero si sey di wahala don end, en heart kon strong more and e nor gri listin to dem, just as Oga God tok.


Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”


So make una help mi beg God, bikos di strong tonda and ice-blok too mush and I go free una and una nor go stay here again.”


Just as dog dey go back go chop en vomit, na so fool dey always show en foolishness.


Wen dem nor kwik ponish pesin wey do bad, pipol go tink sey e dey good to do bad.


So all di pipol and dia leaders kon gri to free dia slave and nor sofa dem again.


But naw, una don shange again and una nor gri respet mi. All of una don take di slave wey una don free before back kon force dem to serve una again.


I go still give King Zedekaya and en ofisas to pipol wey won kill dem. I go make Babilon sojas katch dem, even doh dem don stop di fight for naw.


For dat time, Babilon sojas surround Jerusalem, but wen dem hear sey Egypt pipol don cross dia boundary dey kom, dem kon go back.


But God tell dem, “Israel and Judah pipol, wetin I won take una do? Bikos di love wey una get for mi dey kwik disappear like dew for morning; like dew wey dey vanish wen day dey break.


Dem dey always waka leave mi go meet and follow oda gods wey nor get pawa. Dem nor dey stabol; dem bi like bow wey bend. Bikos dia leaders dey tok anyhow, dia enemies go kill dem, den Egypt pipol go laf dem well-well.”


I go distroy doz wey bin dey woship mi, but nor dey woship mi again. Dem nor dey ask make God guide or bless dem again.”


If pesin katch en enemy, e dey tell am make e go without sey e wound am? Today! Make God reward yu with good, bikos of wetin yu do to mi.


Saul kon ansa, “David my pikin, I don sin! Make yu kom back. I nor go kill yu, bikos yu don save mi today. I bi like fool today and I don make big mistake.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan