God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
So e go di kourt seketry room for di royal palis where all di ofisas dey. Elishama, di kourt seketry, Delaaya, wey bi Shemaya pikin, Elnatan wey bi Akbor pikin, Gemaraya wey Shafan born, Zedekaya wey Hananaya born and all di oda ofisas sidan for der.
Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”
Na like dis una go take make di nomba fifty year dey holy and una go free evribody wey dey stay for di land. For dis year, all di propaty wey dem don sell before, dem go gi-am back to di owner or en relashon. And anybody wey dem sell as slave, go-go back to en family.
Herod dey fear John well-well, so e dey protet am, bikos e know sey John na holy man wey dey do wetin God like. Anytime Herod hear John dey prish, en mind go dey worry am, but e still dey like to listin to am.