Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 33:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Una won go fight Babilon pipol, but una sojas nor betta pass doz wey don die, bikos as I dey vex, I don make up my mind to distroy dem. I don turn from dem, bikos of dia wikedness.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 33:5
16 Iomraidhean Croise  

Nobody dey pray to Yu again; nobody dey kom meet Yu for help again. Yu don hide yorsef and abandon us, bikos of awa sins.


I go really wait for God wey don rijet Jakob family; I go wait for am.


I go distroy dem for dia enemies front like san-san wey breeze dey blow kom from east. I go turn my back and I nor go help dem wen di wahala go start.”


Bikos I don make up my mind sey I nor go sorry for dis town, so I go distroy am. I go gi-am to Babilon king and e go burn am rish groun. Mi, wey bi God, don tok.”


Dem go take Zedekaya go Babilon and e go stay der until I don deal with am finish. Even if e fight Babilon pipol, e nor go win. Mi, wey bi God, don tok.’ ”


Bikos Israel God sey, ‘Just as I pour my vexnashon and fire for Jerusalem pipol, na so too, I go pour my vexnashon for una head, if una go Egypt. Pipol go si una dey fear, dem go hate and use una name as curse. Una nor go ever si dis place again.’


God rijet en own altar kon hate en temple. E allow enemies distroy di walls and dem kon dey shaut inside di temple like sey dem dey do party.


I go pour my Spirit put for Israel pipol body and I nor go leave dem again. Mi, God wey get pawa, don tok.”


But wen una dey trobol, una go kom beg God make E help una! Una dey espect sey God go ansa una? Afta all di wiked tins wey una don do, God nor go even look una face!”


For dat time, I go vex for dem well-well kon leave and hide my face from dem until dia enemies kill dem finish. Many wahala and trobol go ovakom dem and dem go sey, ‘Dis wahala don finish us, bikos God no dey with us again.’


But dat time, I go really hide my face, bikos of all di wikedness wey dem don do as dem dey serve oda gods.


God sey, “I go rijet dem, I go si wetin go happen to dem; bikos dis generashon dey show sey dem too know and dem nor get sense.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan