25 But mi wey bi God don make kovenant with di nite and day and I don make di law wey dey kontrol di heaven and eart.
God put di lite for di sky, so dat e go dey shine for di eart
“As long as di eart dey, time go dey to plant and time go dey to plok wetin dem plant. Sometaims kold go dey and oda times heat go dey. Rain go fall sometaims and oda times evriwhere go dry, but day and nite go always dey.”
God make di moon to mark di mont and di sun dey shine just as God program am.
Evritin dey as dem dey kon rish today, bikos evritin dey work as Yu plan am.
E put dem for where dem dey forever and ever. Nobody fit tok against en kommand.
“If yu fit break di kovenant wey I make with nite and day, so dat dem nor go kom out again for di korrect time,