Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 33:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 I go make my savant, David shidren-shidren and all di priest from Levi tribe plenty, so dat dem nor go fit kount dem, just as dem nor fit kount star for sky or san-san for wotaside.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 33:22
23 Iomraidhean Croise  

And I go make yor shidren-shidren plenty like san-san for di eart and nobody go fit kount dem.


God take am go outside kon sey, “Look di sky and yu go si di stars, den try if yu fit kount dem!” Den God sey, “Na as di stars bi for up, na so yor shidren go plenty rish.”


I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.


Yor shidren-shidren go plenty like san-san for groun and dem go skata go west, east, nort and sout. I go bless all di family for di world with yu and shidren-shidren name.


Awa shidren sef go serve Yu. Awa shidren-shidren go hear about di wonders wey God don do.


I go gi-am one son wey go take-ova from am and just as di days for heaven nor dey end, na so too en kingdom nor go ever end.


Una shidren-shidren for plenty like san-san, like korn wey dem nor go fit kount; nobody go fit remove dia name or distroy dem from my present.’


I go make some of dem priest and some go bi Levi wey dey work for God temple.”


Di pipol wey dey stay der go sing, praiz and dem go shaut for joy. My blessing go make dem many well-well and e go bring honor for dem.


Dis na wetin Oga God tok: “Just as nobody go fit measure di heavens or open di eart foundashon, na so too I nor go ever rijet Israel pipol bikos of wetin dem do. Mi, wey bi God, don tok!”


and na from only Levi tribe priest go for always kom and serve, offa burnt ofrin, korn ofrin and sakrifice for mi.”


So I kon tok as God don tell mi. Life kon enter di body dem and dem kon stand up. Dem many well-well like sojas.


God wey get pawa sey, “All di priests from Levi tribe wey bi Zadok shidren-shidren must kontinue to serve mi, even wen all di odas for Israel nor gri serve mi again. So naw, na dem go serve, enter my present kon offa di animals and di blood for di sakrifice, give mi.


But di time dey kom wen Israel pipol go plenty like san-san for sea wey nobody fit kount or measure. Aldo God dey sey, “Una nor bi my pipol,” but di day dey kom wen God go sey, “God wey nor dey die, na-im bi una papa!”


I go koll and gada my pipol togeda. I go save dem and dem go many pass as dem bi before.


For dat time, God go protet doz wey dey stay Jerusalem and even doz wey weak pass among dem, go dey strong, just as David, dia grand-grand papa bi. David shidren-shidren go lead dem like God angel and dem go bi like God.


Di first angel kon tell di sekond one, “Make yu run go tell di man wey whole di ruler sey, ‘Very soon, pipol and animals go plenty for Jerusalem, sotey di town nor go fit kontain dem again.’


So from dis one man wey en body don die finish, shidren wey plenty rish stars for sky and san for wotaside kon full evriwhere.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan