Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 32:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 So I buy di field from Hanamel kon pay am seventeen pieces for silva.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 32:9
11 Iomraidhean Croise  

Afta di kamels don drink finish, di man bring one gold ring wey dem dey put for nose and two gold shain for waist kon gi-am to di girl.


So wen Midian tradas dey pass, Josef brodas karry am komot di gutta kon sell am give Ishmael pipol for twenty silva. Den dem karry Josef go Egypt.


As di king dey pass, di profet koll am kon sey, “My king, I dey fight war and one soja bring enemy wey dem katch kon meet mi sey, ‘Make yu guide dis man. If e eskape; yu go die or yu go pay 3,000 silva koin.’


All di govnors wey don rule before mi, trobol di pipol and dey kollect forty silva koins evriday for food and wine. Even dia savants dey opress di pipol too. But I difren from dem, bikos I dey fear God.


So my oga, if yu wont, make yu kommand make dem kill all dis pipol. If yu do like dat, den I go get like 10,000 big sak for silva for di royal pus for di kingdom.”


If di melu take en horn wound pesin savant, di owner must pay three shekel for silva and pipol go stone di melu die.


Why una dey spend una money for wetin nor go beleful una? Why una dey spend una money wen una know sey hongry go still kill una? Make una listin and do wetin I tok, den una go enjoy di best food.


Evriday, di food wey yu go chop must nor heavy pass half pound and make e bi for di same time wey use choose.


So I pay fifteen silva koin and seven basket for barley to take bring di woman back.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan