Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 32:43 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

43 Una dey sey di land go bi like desert where pipol or animals nor go dey again. Dem still sey dem go give di land to Babilon pipol. But my pipol go buy field for dis land again.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 32:43
7 Iomraidhean Croise  

Israel God sey, “Pipol go buy many house, field and vineyard for dis land, again.” ’


Even doh Yu know sey Babilon pipol won seize di land, na Yu my Oga God, still orda sey make I go buy di field and do di agriment for pipol present.’


“ ‘Jeremaya! Yu and di pipol korrect wen una sey war, honga and diziz go make dis town fall and Babilon king go seize am. Naw, make yu listin to wetin I get to tok about dis town:


God sey, “Una dey sey, ‘Dis place bi like desert, bikos pipol or animals nor dey stay inside again.’ Una korrect; bikos Judah town and all di street for Jerusalem go dey empty; pipol or animal nor go stay der, but una go hear pipol dey shaut dey happy for dis place again.


God wey mighty sey, “Dis land wey bi like desert where pipol or animals nor dey stay, I go turn am to where fresh green leaf go dey and shepad go take dia sheep go chop for der.


Israel pipol go dey save as dem dey stay der. Dem go build house kon plant vine for der again, den I go ponish all dia neighbour wey ponish dem before. Den dem go know sey na mi bi God.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan