42 “ ‘ “Just as I bring dis wahala for dem, na so too I go give dem all di good tins wey I don promise dem.
And just as I make sure sey dem rut, pul, ova-trow, distroy and skata dem, na so too I go make sure sey dem plant and build dem back again.
God sey, “Di time dey kom wen I go do wetin I promise Israel and Judah pipol.
Jerusalem go bring joy, honor and pride for mi and all di nashons for di world go fear wen dem hear about di good tins wey I go do for Jerusalem pipol and how I go make dia town prosper.”
Nor bi from God mout evritin from kom? Both good and bad?
Heaven and eart go vanish, but my word go still dey.