Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 32:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 Dem build altar for Baal juju for Ben-Hinnom Valley where dem for dey sakrifice dia shidren give Molek god. I nor sey make dem do like dis and I neva even tink about dis kind tin at-all.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 32:35
33 Iomraidhean Croise  

I go do dis tin, bikos Solomon rijet mi kon bigin woship oda gods. E dey woship Astarte wey bi Sidon juju; Kemosh wey bi Moab pipol god and Milkom, wey Ammon pipol dey serve. Solomon nor obey mi; e dey do bad tins and e nor keep my laws and kommand, just as David en papa keep am.


For di east side for Jerusalem hill, e build where dem for dey woship Kemosh, wey bi Moab pipol yeye god and Milkom, wey bi Ammon pipol god.


God go abandon Israel pipol, bikos King Jeroboam don make di pipol sin.”


E sin against God, just as en papa Jeroboam do.


Dis tin happen, bikos Jeroboam make di Oga wey bi Israel God vex, with di sins wey en and Israel pipol kommit.


Dis tins happen, bikos e sin against God. E do bad tins like Jeroboam wey sin and enkourage Israel pipol to sin.


Yor family go bi like King Jeroboam wey Nebat born and like Baasha wey bi Ahijah pikin. Bikos yu don make mi vex, as yu make Israel pipol dey sin.’


“King Manasseh for Judah don sin well-well, E don sin pass Amor pipol wey dey here before and e don enkourage Judah pipol to sin as dem dey serve all dis yeye juju.


E build juju altar for God Temple, even wen God don sey, “Jerusalem na my house.”


Di king skata Tofet for Ben-Hinnom Valley, so dat nobody go fit sakrifice en pikin for Molek juju again.


E still skata di altar for Bethel and na Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin, build am. Den e burn all di high place to ashes kon distroy Asherah juju.


But just like Jeroboam, Nebat pikin wey bi king before am, e still kontinue to lead and enkourage Israel pipol to sin.


E sakrifice en sons for fire for Ben-Hinnom Valley kon dey do juju and many bad-bad tins. E dig one pit and for der, doz wey don die, dem dey koll dia spirit kom back to life. E put majishan make dem dey supavise am. E do many wiked and bad tins wey make God vex.


But Manasseh deceive Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem make dem for sin pass di nashons wey God distroy komot der, for dem.


All di priests and leaders nor kon dey faithful again and dem kon dey kommit bad-bad sins wey all di oda nashon dey kommit. Dem nor kon make God temple for Jerusalem holy again.


Moses kon tell Aaron, “Wetin dis pipol do yu wey make yu kause dis great sin for dem?”


Una dey woship yeye gods and dey sleep with each oda under doz trees. Una dey sakrifice una shidren for di rock wey dey near di stream.


Make una pass Potsherd Gate go Ben-Hinnom Valley. Den yu go tell dem wetin I tell yu, for der.


Doz wey love una, don forget una; dem nor kare about una again, bikos I don attack una like una enemy. Una ponishment go sirious well-well, bikos una wiked and don sin well-well.


I dey send my savants and di profets kom meet dem, so dat dem go stop all dis wiked tins wey I hate,


God sey, “I don rijet Judah pipol, bikos of di wiked tins wey dem do. Dia juju wey I hate, dem put am for my temple kon make di temple dirty.


And dem even build where dem go for dey woship for Tofet wey dey Ben-Hinnom Valley, so dat dem go fit sakrifice dia shidren give juju for der. Dis na wetin I sey make dem nor do! True-true, dat kind tin neva even enter my mind to tell dem.


Dem sleep with pipol husband kon kill many pipol. Dem sleep with juju kon kill di boys wey dem born for mi. Dem sakrifice my shidren give juju.


“ ‘Make una nor give una pikin as ofrin to Molek juju, bikos e go disgrace Oga God name.


‘Na bikos of di house wey una build for “Molek and Refan”, wey bi una god and juju wey una dey woship, naim make mi send una go bi slave for Babilon.’


Una must nor woship di Oga una God, just as di oda kountry dey woship dia own gods, bikos all wetin dem dey do take woship dia gods, na tins wey una Oga God hate well-well. Dem even dey burn dia shidren as sakrifice for dia gods.


For ezample, make una nor burn una shidren as sakrifice. And make nobody learn how to dey tell pipol dia future;


di first husband nor go marry am again, bikos di woman nor dey klean and dis tin nor dey good for God eye. Make una nor bring problem kom di land wey di Oga una God dey give una.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan