E remove Asherah juju pole from God Temple kon burn am outside Jerusalem for Kidron Valley. E burn am to ashes kon trow am put for where dem for dey beri pipol.
All di priests and leaders nor kon dey faithful again and dem kon dey kommit bad-bad sins wey all di oda nashon dey kommit. Dem nor kon make God temple for Jerusalem holy again.
I go do am, bikos di pipol don forget mi kon dirty dis place as dem dey sakrifice give gods wey dem or dia grand-grand papa or Judah kings nor know and dem kill innocent pipol for here too.
Doz wey love una, don forget una; dem nor kare about una again, bikos I don attack una like una enemy. Una ponishment go sirious well-well, bikos una wiked and don sin well-well.
Una bin shange kon dey do wetin I wont. All of una gri to free una slave and una enter kovenant for my present; for di temple where dem for dey woship mi.
Wen una don do all dis tins wey I hate finish, una go kom stand for my present inside my temple kon dey sey, ‘Wi dey save!’ Una tink sey una really dey save wen una dey do all di tins wey I hate?
And dem even build where dem go for dey woship for Tofet wey dey Ben-Hinnom Valley, so dat dem go fit sakrifice dia shidren give juju for der. Dis na wetin I sey make dem nor do! True-true, dat kind tin neva even enter my mind to tell dem.