27 ‘Na mi bi di Oga wey bi evribody God. Nor-tin too hard for mi to do.
E get anytin wey too hard for God to do? As I tok before, nine monts from naw I go kom back and Sarah go born boy.”
Elisha still sey, “Dis tin dey eazy for God eye. E go give Moab and en pipol to una.
Bikos Yu hear and ansa awa prayers; so evribody go kom meet Yu.
But Oga God, na Yu bi awa papa. Wi bi klay and na Yu mold us. Na Yu kreate us,
‘My Oga God! Na Yu kreate heaven and eart with yor mighty pawa and great strent. Nor-tin dey hard for Yu to do!
“Den God ansa mi,
“Koll mi wen yu dey pray and I go ansa yu; I go tell yu great and wonderful tins wey yu nor know about.
God wey dey lead heaven sojas sey, “My pipol wey remain fit tink sey all dis tins nor dey possibol, but with mi wey bi Oga God wey get pawa well-well, evritin dey possibol.”
Den God ansa, “So yu tink sey God hand short well-well? Naw, yu go si weda my word go happen or not!”
Den dem fall face groun kon sey, “My God, di God of all pipol spirit, Yu go vex for di whole kommunity wen e bi sey na only one pesin sin?”
“Oga God wey dey give life, make Yu choose one man wey go lead di pipol,
Jesus look dem kon ansa, “E nor possibol for human being, but evritin dey possibol with God.”
and evribody for dis world go si God salvashon.’ ”
Just as yu don give mi pawa ova all di pipol for di world, na so too I go give life wey nor dey end to evribody wey yu give mi.