Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 32:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Even doh Yu know sey Babilon pipol won seize di land, na Yu my Oga God, still orda sey make I go buy di field and do di agriment for pipol present.’

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 32:25
11 Iomraidhean Croise  

Yu waka on-top di sea go diliver yor pipol kon strol pass di great river, but nobody fit si yor footstep bikos e nor show at-all.


Dark kloud dey round am. Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne.


I go bring war, honga and diziz kom meet dem, until nobody among dem go remain for di land wey I give dem and dia grand-grand papa.’ ”


Israel God sey, “Pipol go buy many house, field and vineyard for dis land, again.” ’


Si as Babilon pipol build dia kamp round di town and dem won seize and attack am. Dem go win, bikos war, honga and diziz don already dey kill yor pipol. Naw, make Yu si sey evritin wey Yu tok, don dey happen.


Una dey sey di land go bi like desert where pipol or animals nor go dey again. Dem still sey dem go give di land to Babilon pipol. But my pipol go buy field for dis land again.


So, Hanamel kom meet mi for di kourtyard sey make I buy en field, just as God tok. Den, I kon know sey, God really tok to mi.


“Naw, mi wey bi God sey, ‘Una don disobey mi; una nor gri free una brodas and sistas. Since na like dat, I go free una so dat war, honga and diziz, go kill una. I go make evry nashon for di world fear for wetin I go do to una.


Jesus ansa, “Yu nor go fit undastand wetin I dey do naw, but yu go undastand am leta.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan