Israel pipol go dey save as dem dey stay der. Dem go build house kon plant vine for der again, den I go ponish all dia neighbour wey ponish dem before. Den dem go know sey na mi bi God.”
I go bring my pipol kom back to dia land. Dem go ribuild dia towns wey skata kon stay der again; dem go plant vine kon drink di wine; dem go plant food for dia farm kon chop wetin dem plant.
Den my pipol wey dey Negev go kollect Esau mountin. Doz wey dey stay near di hill for Judah go take di betta land wey dey Filistia, Efraim and Samaria. Den Benjamin pipol go take Gilead land.
“So mi wey bi God go turn Samaria to where pipol go dey trowey dirty put and dem go dey plant vine for der too. I go skata en stones for di valley kon espose en foundashon.
Evribody go stay for peace and dem go prosper. Dem go enjoy dia own grape and fig tree, bikos e nor get anytin wey go make dem fear. God wey dey mighty don promise!
And for dat day, una go invite una neighbours make dem kom sidan with una under una vine and fig tree, bikos una go get peace.” Dis na wetin Oga God tok.
E get anybody for here wey just plant vineyard and neva chop anytin from am? If na so, yu fit go house, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go chop di first fruit for yor harvest.
Di woman wey una dey won marry, anoda man go rape am. Una go build house, but una nor go fit stay inside. Una go plant vineyard, but una nor go chop dia fruit.
David tell di priest, “True-true, dem nor dey sleep with wimen wen wi dey go war. Dia swods sef dey holy, even doh na ordinary journey wi dey go. So today, dem even dey holy well-well!”