Na Bet-Shemesh, Israel king, Jehoash for katch King Amazaya wey bi Jehoash pikin and Ahazaya grand-pikin. E attack Jerusalem kon break di wall from Efraim go rish di korna gate wey long rish six hundred fit.
Den I leta tell dem, “Make una si di kind trobol wey wi dey face, bikos Jerusalem don skata and en gates don distroy! Make wi ribuild di town wall, so dat shame go komot from awa eye.”
Eliashib wey bi di high priest and en oda priests build di Sheep Gate, dedikate kon put di doors as dem suppose dey. Dem build go rish di Hundred Towa and Hananel Towa kon dedikate dem too.
Na mi tell Cyrus sey, ‘Na yu bi di pesin wey go rule; yu go do wetin I wont make yu do. Yu go orda make dem build Jerusalem again kon ribuild di Temple.’ ”
God sey, “Di time dey kom wen I go choose betta king from among David shidren-shidren. E go rule di land with wisdom kon do wetin dey korrect and good.
“So make yu know and undastand sey, ‘From naw wen I tell yu dis message, till di time wen dem go ribuild Jerusalem and di leader wey God choose go kom, e go bi seven weeks and sixty-two weeks. Dem go build di town well again, but wahala go dey for dat time.
All di land from Gibeah aria go rish Rimmon wey dey di sout, go klean like Arabah. But Jerusalem go high pass oda land wey dey round am; di town go start from Benjamin Gate go rish di Korna Gate kon from Hananel Towa go di Royal Wine press.