I make kovenant with una sey: I don give una my pawa and word forever and from naw go, make una dey obey mi kon tish una shidren and shidren-shidren, so dat dem go obey mi forever.”
God sey, “Di time dey kom wen I go choose betta king from among David shidren-shidren. E go rule di land with wisdom kon do wetin dey korrect and good.
bikos time dey kom wen I go bring my pipol, Israel and Judah kom back to di land wey I give dia grand-grand papa and e go bi dia own again. Mi, wey bi God, don tok.”
I go make kovenant wey nor dey end with dem sey I nor go ever stop to do good tins for dem and I go make dem fear mi with all dia heart, so dat dem nor go turn leave mi again.
I go make kovenant with dem wey go make dem dey save forever. I go make dem prosper and dem go many well-well. I go make sure sey my temple dey for dia land forever.
God sey, “Di day dey kom wen korn go kwik grow even before harvest time rish and grape go grow kon ripe before dem suppose make wine. Sweet wine go dey rush kom out from di mountins and wine go dey flow for di hills.
Afta dem chop finish, Jesus take di cup kon sey, “Dis na my blood wey God take make new kovenant with una. Make una always dey drink am to remember mi.”
Na God make us fit do dem, so dat wi go serve di new kovenant; dis nor bi di law wey dem rite, but na di one wey koncern God Spirit, bikos di law wey dem rite dey bring deat, but di Spirit dey give life.
Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.
Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.
Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey.